10 correct reasons to use Ayoba

E FREE TO USE

Ayoba dey free to use. You go need data to send messages and files to your contacts dem, but some networks (e.g MTN) fit give this data for free too.

SHARING NA CARING

Share videos, pictures, audio, and other files dem with your contacts.

QUICK CONNECT

Use your current address book make e easy to connect with your contacts dem quick quick.

CALLS

Use your voice connection take make calls inside the app.

GIST NOW

Send and receive text and voice messages dem with any of your contacts instanta.

E SECURE

End-to-end encryption mean say wetin you dey talk for inside message another person no fit read am.

FOLLOW EVERYBODY CHAT

Send SMS text message with anybody for your contact list, e no matter weda dem don install Ayoba or dem never install am.

MAKE WE MEET

Share your real-time location with your Ayoba contacts dem.

GROUP CHAT

If e plenty, naim sweet pass! Arrange group chats make e for easy to communicate with friends and family dem for inside one chat.

MONEY TRANSFERS

Pay for things and receive payments with Mobile Money (e go soon come).

Who we be

Ayoba na free instanta messaging app,

wey Africans design for fellow Africans.

Although Africa na one world, e get different cultures wey pass hundred. To celebrate the different things wey dey inside Africa we dey give world-class messaging platform wey dey reflect everybody need and wetin dem go like do for their own level.

From day one, Ayoba don involve correct security wey go protect the sender and the receiver, so nothing go affect their privacy. E mean say talk wey you message one person, another person no go fit read am, even the people for Ayoba no go fit sef. 

We do am so that everybody go dey involve make people wey dey use Ayoba fit communicate with anybody wey get handset, even if dem never get the Ayoba app.

Right now, Ayoba dey available for anybody wey get Android handset to download (all the other people, their own go soon come out!). On top that one, we get correct agreement with MTN, wey mean say we fit give free* Ayoba data to every MTN subscribers anytime dem send message, picture, videos and other things to their contacts. On top that one again, any reply you send to message wey come from Ayoba go dey free* for MTN subscribers, e no matter if dem dey use the app or dem no dey use am.

Wetin be Ayoba next plan

We get plenty sweet new ideas wey we don plan for the next few months as we dey spread out for the whole Africa. Inside am, person go fit send and receive money inside Ayoba, to their contacts for Africa, with Mobile Money.